E get people wey you go dey talk to for Oyibo language dem no go dey understand wetin you dey yan well. Na im make we feel say even for class we suppose begin dey use language wey all man go understand. For boku boku places for Africa na pidgin English you go use make everybody understand you weda de person go school or not. Na im make we dey ask the oversabi people for our society wetin be gender for pidgin English. Since una don sabi wetin gender mean for oyibo man language una fit tell woman wey dey village wetin gender mean in case una want mobilize rural women make dem join for gender advocacy fight?
NB: In this era of globalisation people at the periphery of the communication process require identification with the language they easily understand for messages to make meaning to them. Pidgin English is one language pattern that penetrates parts of English-speaking Africa despite educational or literacy background.
The issue of gender is a topical one which people of various literacy backgrounds wish to understand. Here are attempts at defining gender in pidgin English for those who seek knowledge even in its raw form.
Wetin Be Gender?
D tin wey we de look at and talk about woman and man for we housi, villa and communiti na him Oyibo de call gender.Even sef diferent pipo de look at gender in so many weys. Example be say fo Obodo Oyibo and Naija, d wey we de look at man and woman diferentoo. We de learn gender mata everiday fo we house, society and skool. Gender no be de same ting as sex. No mix the two befor you go cause katakta. – Anthony Onyima
Any time wey we talk gender matter, BBC dictionary, wey be book wey dey show wetin matter be, talk say gender na in be many many things wey oyibo call characteristics wey be things wey we society and country people dey give person becos say person be man abi woman. If person be man abi woman na so God take do am. But our country people get as them dey take see woman becos say ibi woman and man becos ibi man. Plenty plenty way, wey we country people dey take see man-woman matter no dey help. Ino dey help country people see and do wetin dey good for our country. Example be say our country people no dey allow woman get wetin be them own becos them be woman. Dis way we no fit develop and live better life wey God give all of we to live. – Jude Okoye
Gender na d name wey de call pesin wey wen ice take de behafe plus how ide de social to do things. Gender na d word people de use becose of him character plus behave as he de d things. – Festus Ntomchukwu
Dis na talk about how society tek see life of human being, man and woman as it concern wetin dem fit do, dress dem fit wear, even job dem fit do or position dem fit occupy. Like now for our country, many people especially our men no gree say woman fit be President; say fit drive commercial moto. Even wen dem see woman dokito or Engineer, e no dey too clear dem fo eye. For church, who be woman to be Fada, pastor or even to com preach. For tradition sef, na dia e woss. Woman no fit be King, em no fit comot vileg square talk or inherit property. – Genevieve Nwedo-Nzeribe
Gender na the roles wey person suppose do, wetin the society say make them Dey do.the gender Be wetin the society say make man and woman Dey for for them and this roles or work dey according to whether the person be man or woman. The society expect say man go behave like man and woman go behave like woman. – Marypetra Dimokwu
Gender fii be system of roles and relationships wey we fii see between women and men wey we no go talk say na biology carry am come rather we go reason am via social, political and economic level. Gender na one kin social construct wey be say societies dey expect to dey see or say dey don carry different roles come give men and women. If you want talk about gender, na im be say you want dey yan about who we be and wetin we dey do.Na for gender you go see every every wey concern the role society dey expect make you play. – Olileanya Orakwelu
Gender na role and task wey man or woman dey do for inside the society wey dem know am for public say dis na wetin man or woman suppose dey do or how man or woman suppose dey behave. – Faith Iwuagwu
Wetin Be D Difference Wey De Between Gender and Sex?
Some pipo go de tink badi badi tings wen them hear about sex. Make I tell you, sex no bi dat bad ting you cari for mind. Sex bi de wey God make us fo our mama bodi. E get someting wey God put fo woman belle wey be like water. Oyibo de call m androgen. Na d ting dey cause weda we go be boy or girl.At time too, dat angrogen fit make somebodi e no be boy or girl. Some pipo like dat de fo dis world. Oyibo de call them’intersex’.
But gender na diferent mata.Gender b de ting wey we de take our mouth talk say woman or man be. Wetin e mean to be woman or man in everiday life. Dis de start from we village and even de wey we de live.Some pipo de take dis gender mata de put woman or man down in their talk talk or wetin de write. Dis gender mata don cause many casala for we society. – Anthony Onyima
Gender and sex no be de same thing dey mean oo. Gender na the many things
wey be characteristics wey country people dey carry give man becos say ibi man and woman becos say ibi woman. Dis things wey be characteristics no be as God take do am oo. Na we country people take our hand putam. Say woman no fit be oga for we country becos ibi woman. Woman no fit go school becos ibi woman. As ibi for sex, na de things wey God put person for body wey makam man abi woman. Example be woman get body wey go helep make she be mama, carry belle, born pikin and give pikin breast. Man get body wey go help make he give woman belle. Our country people dey take becos woman sex mekam woman ino fit challenge man. Say man dey better pass woman becos man get sex body wey mekam be man. Ino bi so. Woman fit do many things wey man fit do. Na so Nwanmuo(2018) talkam for inside Nwodu and Osunkwo(2018). Okunna and Omenugha(2015) talkam so well well. – Jude Okoye
Sex different from Gender: Sex na wetin pesin carry com for did world. Na as him God take make d pesin as them bornam man or woman. Wen we see dos things as nature take create d pesin,naibi sex.Sex mean sey,d pesin na male (boy) or female (girl). But gender na wetin people dey call pesin as girl or boy as him character or social life de show. As him de act and de behafe,na gender not sex. Infact sex na nature de show wetin de pesin as his his body,head,hair,even eyes d show. – Festus Ntomchukwu
Dis eye wey society tek see gender difrent wen e konsan wetin oyibo kol “sex of a human being”. For sex mata, wetin society or even too much akada people de consider na how God take create person sake of the kine body dem givam. Fr man body, dem go look for em chest weda e carry breast. Then, dem go check em private area weda na man private part abi na woman own e get. Some people dey even carry in-between. Dis na people dem dey kol ‘intersex’
For dis mata, some country like Germany and Finland or even for some big big akad people, diaris no difrense for the two, gender and sex, all na the same. Even some people wey say dem be Transgender, no gree say dem be man or woman. Some of dem dey tek dia mouth tell you the one dem wan be. E no mata weda dem carry man or woman body. – Genevieve Nwedo-Nzeribe
De difference between gender and sexuality be say: gender na roles way the society say make the man and the woman go dey do for the society and wetin the society say make man dey do, make man behave like man and no be like woman while sexuality na the biological features way them dey use know say this person na man and say the other person na woman, na how people dey take know man and woman. – Marypetra Dimokwu
Sex na the biological features or role of a person, while we go talk say Gender na roles wey them don give person, wetin don make person a man or woman for society. Na for sex we go talk say person na woman or im be man. Na the roles wey dem don give person na im we go see as gender. Na da role wey be gender, you no go take am as sex because say this one(sex), na biological features.
We fit see men wey be male sexually but their gender dey show say dem be female o even dis kin tin fit dey women dem side. – Olileanya Orakwelu
De difference between gender and sexuality be say, gender na the role, function and task wey dey differenciate a man a from a woman but sexuality na biological features wey dey tell us say a man na man while a woman na woman. – Faith Iwuagwu
If you can define gender in pidgin English provide it in the comment box below.