Tuesday , March 26 2024

In Case You Missed This! See How BBC Reported COOU Mass Comm Best Graduating Student’s Yam and Fowl Award

Sometime last year, that was in October, the internet buzzed with reports of a student of Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University (COOU), Best Nwabuwa was given a yam tuber and live fowl as best graduating student of the department of Mass Communication.

Well, Nwabuwa instantly became an internet sensation and was interviewed by BBC News Pigdin English service reporter. That was an amazing story. Read the report below.

Why dem give dis ‘Best Graduating Student’ yam and fowl

 

Di Best Graduating Student for Mass Communication department for Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University, Anambra State for southeast Nigeria, Best Somadina Nwabuwa, say im no bin dey expect di kain gift wey im receive.

Internet bin scata last week, wen foto dem come out of Mr Nwabuwa as im wear suit, hold yam for one hand and live chicken for di oda hand as gift dem wey im receive as best graduating student for im department.

“I bin no expect dat kain gift,” im tell BBC Pidgin.

Di tori wey bin full ground na say na di department give am di gift, but BBC Pidgin find out say na one lecturer, Dr Chinenye Nwabueze, give as as im own personal gift.

BBC Pidgin follow di lecturer tok, and im say wetin make am give di student yam and fowl, na to make am understand di value of agriculture.

“Once student do well for my class, na wetin I dey use encourage dem,” im tok.

“We believe say even if you go school, agriculture na somtin wey pesin fit fall back on.

“Dis na di number five time wey we dey do di award, and we don give tins like vegetables, egg, plantain, potatoes and watermelon wey dey compulsory.

“Di fact say best graduating student get yam, na im make pipo dey tok about am. E fit dey funny, but di boy don go global. We dey use oddity to announce di award to di whole world,” Dr Nwabueze tok.

Di student wey im name na Best Somadina, say im happi sha as im win di award and im thank di lecturer.

“Di gift na to draw my mind to agriculture and I surprise sha.

“Pipo bin dey expect say I go collect gift wey relate to book tins, so wen I come get yam and fowl, dem begin laff.

“Di best price for be money na, and e for encourage oda students. Wen dem see pesin wey finish as best for im department cari yam and fowl, dem begin wonda weda I be native doctor. If to say I get laptop, or 500k to help me go do masters, e for make sense,” im tok.

Wen BBC Pidgin ask am wetin happun to di yam and fowl, im say e give dem to im mama.

See BBC News Pigdin

 

 

About Chinenye Nwabueze

Nwabueze is a writer with passion for cutting-edge news

Check Also

Male humpback whales caught on camera having s3x

Two humpback whales have been caught on camera engaging in homosexual s3x. A just-published study …

Leave a Reply

Your email address will not be published.

%d bloggers like this: